Article informationOne ogbonge food content creator for Nigeria tok of how she no fit drink hibiscus flower drink wey pipo for Nigeria sabi as zobo drink wen she get belle start conversation of how safe di drink dey.
For post wey go viral, she reveal how she get preterm contractions wen she drink zobo during her pregnancy.
She say, "I tink say di myth around taking zobo wen you get belle dey correct, I bin dey hear before say e dey cause contractions. E dey even cause miscarriage.
Wen my belle don reach four months, I drink zobo, na so I start dey get cramps, immediately. But me I get coconut head, so I reason say e fit no be di zobo. My neighbour and friend tell me say make I no take am ooo, but as I dey pregnant, na di zobo dey hungry me."
Afta she drop di video, plenti women start to dey come out with dia tori on dia own experience wit zobo during pregnancy.
Di mata create ogbonge tok-tok for social media as some pipo gree say e no good and odas claim say, "na di official drink of antenatal."
Skip Twitter postAllow Twitter content?Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Accept and kontinuWarning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.End of Twitter post
Sake of dis, we decide to chook eye for di mata.
Zobo na local drink from hibiscus plant and na so e dey very popular for Nigeria.
Dis zobo (Nigeria hibiscus flower) get beta health benefit for women for dia period and during menopause, e dey help with liver, fever, constipation and hair breakage.
Di American National Library of Medicine tok say di plant wey dem dey take make hibiscus sabdarifa na plant wey dey seen as safe for amount wey dem dey commonly take chop.
Several oda names dey wey dem dey call di tea along different places wey dem dey use di plant.
Wetin sabi pipo tok about zobo and pregnancy
Dr Abosede Olowofoyeku wey get PhD in Drug Discovery and Development From Nature tell BBC Pidgin say many ways dey wey dem dey take prepare di zobo wey pipo dey drink and e get plenti effect for bodi.
One of di method na to boil am for at least one hour.
Den di one wey you go sieve inside hot water dey.
And di final one wey dem dey call cold extraction, involve pesin to soak zobo leaf for inside water for up to 72 hours.
She say, "if you use cold extraction method e go cause abortion";
She reveal say of di three, one of dem be di safest to use wen pesin get belle. She say "all dis preparation dey give am different effects, both medicinal and oda effects."
She say, "di way to make am safe for woman wey carry belle na to boil am and to boil am for a long time."
She add say, "di plant chemicals wey dey contract di uterus, dey heat sensitive. So if you prepare am with cold extraction or you prepare am with boiling, e get two totally different effects"
Pineapple wey be one of di common tins wey pipo dey use take sweeten dia zobo also get wetin dey contract uterine walls and fit commot belle.
"Pineapple na one of di ways dem dey carry sweeten zobo and some pipo go use every part of di pineapple plus including di middle.
"Dat middle get wetin dem dey call bromelain and e fit also contract di uterus," na wetin Dr Abosede tok.
She advise say to take am and dey on safer side na to comot di core, come boil am, as heat dey also comot bromelain and di compound also dey oda parts of di pineapple.
Which beta tin wey zobo dey do for bodi?

Zobo get plenti antioxidants for inside am.
Specialist Dietician, Onoja Deborah tell BBC Pidgin about di effects of zobo for bodi.
Di UK and Nigerian registered dietician say, "zobo get plenti compounds like antioxidants like flavonoids and anthocyanins, wey dey help with reducing di risk of chronic diseases like heart disease and cancer."
Dr Abosede tell BBC Pidgin say, "zobo get one dark red colour and dat kain colour dem dey find am inside oda plants wey dem dey call, anthocyanin. Dem dey useful for plenti tins and na wetin you dey get from zobo too."
"E get anti-cancer, e get effect on fibroid and enlarged prostate. Dem get effect for blood. Some pipo dey use am as herbal blood tonic. "
Weight management
She reveal say e dey help with weight management, blood pressure issue and cancer.
Onoja explain di way e dey help with weight say, "hibiscus extract fit affect di amylase enzyme wey go reduce di way bodi dey take absorb carbohydrate and like da fit epp pesin with weight management."
Hypertension
Onoja tok say, "studies don show say anthocyamins for hibiscus flowers dey help reduce blood pressure by say dem relax blood vessels and na so dem fit help manage hypertension."
Zobo compounds get diuretic properties wey dey affect urine output and electrolyte output, according to Onoja.
Meanwhile, Dr Abosede explain say wetin dat one mean be say, "by affecting di level wey pesin dey piss, e dey allow pipo to release sodium for inside dia bodi wey be one of di tins wey dey cause hypertension."

Cancer treatment
Dr Abosode reveal say hibiscus extract wey dey prepared differently dey also help with some kain cancer treatment.
She say, "e get di way di preparation of di extraction dey take tighten di uterine wall wey dey cause abortion and e get how you go make am wey be say e fit help with cancer treatment."
Howeva, di preparation of dis kain zobo different from di normal ones wey pipo dey drink as beverage. She reveal say "instead of water wey pipo dey use extract di zobo comot hibiscus normally, for cancer, e get anoda tin wey dem go use as di solvent to take extract di zobo from hibiscus".
Wetin be di downside of taking zobo?
Hypotension, stomach pain and affecting medication wey pesin dey take na some of di negative side events wey dey come with taking zobo excessively.
Mrs Onoja say, "if pesin drink plenti zobo, e fit lead to hypotension wey mean low blood pressure especially wen di pesin wey dey drink am also dey on blood pressure lowering medicine."
"Dem go be some level of interaction between herbs and medicine.
E depend on di kain medication wey pesin dey take.
Dem be three ways wey e dey take interact with medication," na how Dr Abosede take explain am.
She go on to add say dem fit no be any difference for how di drug and extract dey interact.
Di second one na inductive effect, wen di herb go fit increase di amount of drug for di blood sotay e go turn from therapeutic threshold, wey be di amount wey suppose dey without wahala, to toxic amount for bodi.
Di third way na to make am less effective by say e lower di amount of medicine for your bodi to sub therapeutic levels.
Dr Abosede also tok say e dey possible say zobo fit make pesin dey poo-poo, but "I tink e dey based on wetin dem add put for inside di zobo cos on im own, e get very mild laxative effect. So wetin dem go don add fit don multiply dat effect to make pesin dey stool nonstop."
ncG1vNJzZmivp6x7o67CZ5qopV%2BltqWzyKdmmqqknrCtsdJomqWvoK29pYPQapyo